Yan Me Tori

Yan Me Tori "Yan Me Tori" is the premiere Film Screening Event in Jos, Nigeria.

‼️ J-TOWN FILMMAKERS, GATHER HERE ‼️You get short film wey no send? Wey dey edgy like razor blade? Wey dey disruptive so...
01/04/2025

‼️ J-TOWN FILMMAKERS, GATHER HERE ‼️

You get short film wey no send? Wey dey edgy like razor blade? Wey dey disruptive sotay e dey make elders dey ask, “Who shoot this film?!” Then, Yan Me Tori dey find you!

WETIN WE WANT?
✅ Films wey dem shot for Jos or by Jos filmmakers (We rep J-Town, no be for play).
✅ Must be fearless, edgy, and disruptive—if e no shake table, you sure say na film you shoot?
✅ Submit between April 1 - April 20, 2025 (No be April Fool, we no dey joke!).
✅ Send your film & EPK go [email protected]

If your film dey scatter brain, expose secret, or make person laugh sotay belle go begin pain am, na you we dey find o!

No dull yourself!

Tag your filmmaker padi dem. Make we yan una tori! 🎬🔥

And if you wan make chikini money, by joining hand with us to sell our ticket o, send us message for: [email protected]

See, for every ticket wey you sell, you get N500 inside.

P.S: We still never find justice for Chike o!😂

Address

Jos

Website

Alerts

Be the first to know and let us send you an email when Yan Me Tori posts news and promotions. Your email address will not be used for any other purpose, and you can unsubscribe at any time.

Share

Category